Aguero: Barcelona complete move to sign Manchester City striker on two-year deal

Sergio Aguero

Wia dis foto come from, Getty Images

Manchester City striker Sergio Aguero go join Barcelona on two-year contract when im current one expire for end of June.

Di 32-year old striker from Argentina, go comot City after 10 years for di club, wia im become dia all-time leading goalscorer wit 260 goals in 390 games.

Im last appearance na when e enter as substitute for Saturday Champions League final defeat by Chelsea.

Aguero go get buyout clause of 100m euros (£86m) for Barcelona.

Im official signing ceremony go happun on Monday, 30 May.

Aguero, wey don win 15 major trophies during im time for Manchester, go join fellow kontri man and close friend Lionel Messi for Nou Camp.

Skip Twitter post
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Twitter post

Aguero EPL achievement

  • Aguero dey number four on di list of Premier League all-time goalscorers wit 184 goals
  • Highest Premier League goalscorer for overseas players
  • For January 2020 e pass Alan Shearer for record of most hat-tricks for Premier League. E get 12.
  • 74 assists
  • 15 trophies - wey include 5 Premier League titles, 1 FA Cup, 6 League Cups and 3 Community Shields
Wetin we call dis Video, Aguero 'proud and happy' after final goals at Etihad